We Bin Be Like People Wey Dey Dream
Na Song wey dem dey sing as dem dey climb go up.
Di people wey dey come back from exile talk say di homecoming be like dream and e fill dem mouth with laughter — den dem ask our Papa for more restoration, like streams wey dey return to di Negev. Di promise for now be say those wey dey sow with tears go come home carry bundles of grain.
126 1When our Papa bring back di good things of Zion, we bin be like people wey dey dream. 2Den laugh full our mouth, and shout of joy full our tongue; den dem talk am among di nations sey, “Oga don do great things for dem.” 3Our Papa don do great things for us; gladness full our belle.
4Bring back our good things, our Papa, like di streams for di Negev. a a v4 Di Negev na di dry desert for di south side of Israel, wia empty riverbed dey suddenly full with water afta di rain don fall — e be like picture of how person condition fit change sharp-sharp. 5People wey dey plant with tears go harvest with shout of joy. 6Anybody wey comot dey cry, wey carry di bag of seed to plant, go surely come house with shout of joy, wey carry bundles of grain.