I Dey Lift My Soul Give You
Na David own.
David beg make dem teach am, no be only rescue am — show me your ways. E bring both im enemies and di sins of im young days and beg make neither one define am. Our Papa dey share E covenant like friend with dose wey fear am.
25 1To you, my Papa, I dey lift up my soul.
2My Papa, na you I trust; no let shame catch me; no let my enemy win me. 3For true, shame no go catch anybody wey dey wait for you; but shame go catch dem wey dey betray for nothing.
4Show me your road, my Papa; teach me your paths. 5Lead me for your truth and teach me, because na you be our Papa, my salvation; I dey wait for you di whole day. 6Remember your tender mercy wey dey pain belle, my Papa, and your Covenant love, because dem dey from long-long time. 7No remember di sins wey I do for my young age or my rebellion; remember me according to your Covenant love, because of your goodness, my Papa.
8Our Papa good and E dey do di correct-and-holy way; na why E dey teach sinners di road. 9E dey lead di people wey dey humble for justice, and E dey teach di humble ones im way. 10All di paths of our Papa na love wey dey loyal and faithfulness for dem wey dey keep im Covenant and im testimonies.
11Because of your name, my Papa, forgive my sin, because e big well-well. 12Who be di person wey dey fear our Papa? E go teach am di road wey e suppose choose. 13Im soul go rest for better condition, and im pikin dem go inherit di land. 14Di close friendship of our Papa dey for dem wey dey fear am, and E dey make dem know im Covenant. 15My eye dey always look our Papa, because E go free my leg comot from di net.
16Turn come me and show grace give me, because I dey lonely and dem dey trouble me. 17Di troubles wey dey my heart don plenty; bring me comot from my distress. 18Look my suffer and my hardship, and carry all my sins comot. 19See my enemy dem, because dem plenty, and dem hate me with wicked hatred.
20Guard my soul and save me; no let shame catch me, because na inside you I dey hide. 21Make integrity and correct way protect me, because I dey wait for you.
22Redeem Israel, our Papa, comot from all im troubles.